Fans of Ahmed Ololade alias Asake dey react to him new facial tattoo reveal.
Di YBNL signee reveal him new look few days ago as him de try to promote him new song Why Love on his new Instagram page.
Di new look show sey di Lonely at the Top singer cut him dreads and him don get new facial tattoo to add to him many body tattoos.
Fans’ reaction to Asake’s new look
After di new look reveal, fans of di superstar react differently across different social media platforms.
Most of them de show concern as them dey suggest sey di singer fit no dey alright while others de try compare him former self to do new look.
Di height of di reaction na di comparison between Asake and Habeeb Okikiola Badmus, popularly known as Portable.
Don’t compare me with Asake
After di comparison with di Sungba crooner, portable don warn people wey de compare am with Asake sey make them no compare am with di singer as him no look like di singer.
Portable further talk sey di person wey him resemble na lil Wayne, no be Asake.
Since him new look reveal, many of him fans still de try accept him as them believe sey him fit de go through a lot wey make am wan change him look.
Social media reactions
“He is losing his mind” says one X user @Abdurazaq64
“Those Asake tats are getting too much, he needs to slow down on em”, says @Guccistarboi
“what’s with all the earrings on the ear, I hope he’s not being initiated into illuminati”, says @ejiro_joshua1
“Facial tattoo makes Asake look like a thief”,@it_Ruthie
“As a big fan of Asake who has never seen anything wrong in him since he blew up; I’d just say this tattoos didn’t enter. They don’t look good on him”, says @ItsShola