Immigration News Canada on Thursday, January 16, reveal sey Nigerian students dey among di 50,000 students wey de miss.
According to di report, 50,000 international students wey them give study permit for 2024 no show up.
Among di 50,000 students, Nigeria, Ghana, India, China and six other countries get di highest number of students wey no report.
50,000 international students vanished into thin air under Trudeau’s broken immigration system
Schools rake in $ but skip accountability
✉️ RCMP is “reaching out”? A polite email won’t fix this
Marc Miller’s “tough talk” = duct tape on a sinking ship
This isn’t immigration;… pic.twitter.com/gHU3TM4Dlb
— Marc Nixon (@MarcNixon24) January 15, 2025
“In one shocking revelation, close 50,000 students wey them give study permit make them further their education no turn up. According to Immigration Refugee and Citizenship Canada (IRCC) this na like 6.9% of all di international students “.
Based on di report, India naim de lead di data of students wey no show with 20,000 students missing. China follow with 4,700 students.
Nigeria de follow China with 3,900 students and Ghana get 2,700.
Di other countries wey follow inside di top ten na Iran, di Democratic Republic of Congo, Bangladesh, Vietnam, Rwanda, and di Philippines.
Causes of increased non-compliance rates
Di report also show different compliance rate for di different countries. India get 91.1% compliance rate, Nigeria get 84.7%, while Ghana get di lowest compliance rate of 67.4%.
According to travel experts, them talk sey some factors wey dey cause non-compliance for international students na agents wey de extort students, illegal border crossing and students wey de choose work over school.