For Tai Solarin University of Education (TASUED) for Ijebu Ode, Ogun State, cultists dem waka enter exam hall, drag Ola Fabiyi, one final year student wey suppose sign out on Thursday, July 4.
Eye witness people talk say the TASUED cultists dem beat am well well before dem later shoot am.
At first, people dey hope say Fabiyi fit survive, but later dem don confirm say the guy don kpai.
A final-year student at TASUED in Ijebu Ode, Ogun state, Ola Fabiyi, has been k!lled after suspected cultists, who stormed his examination hall, dragged him out and fatally beat him to his death yesterday pic.twitter.com/GAjONntXfY
— Naija (@Naija_PR) July 4, 2024
Dem say that the TASUED cult boys wey attack Fabiyi na the Aye cult group. This kain bad news don make people dey shout again say make we reject cultism and the wahala wey e dey cause.