Davido don sue him baby mama, Sophia Momodu

Davido and sophia momodu 1000x600 1 636x382 1 Davido don sue him baby mama, Sophia Momodu

International singer, David Adeleke A.K.A Davido carry him first baby mama Sophia Momodu go court.

The reason for de drag wey him de drag Sophia na onto sey him de demand custody for di pikin Imade Adeleke, wey two of them born.

Inside di suit wey him lawyers Dr. Olaniyi Arije, Okey Barrah and some others file, di super star de ask sey make di court give am joint custody with Ms. Momodu. And this lawsuit de carry date of April 17.

Di lawsuit wey get number LD/1587PMC/2024, e show sey na Mr. David Adeleke be Di applicant and na Sophia dey as di only respondent.

Inside di news wey popular Instagram blogs like Lindaikejiblog don carry, e show sey di award-winning singer use 44-paragraph affidavit take support di motion.

Him tok for di paragraph sey him been get relationship with Ms. Momodu and di relationship produce pikin for May 14, 2015.

Sey them been agree sey them go both take care of di pikin as di pikin “biological papa and mama”.

Davido further tok sey “evidence boku wey show sey him dey responsible for all di pikin school fees to make sure sey she go good school.

“Him also pay Di rent where Sophia de stay with their pikin”

Sey because of how him take love di child, him buy house for #200mil insid tush environment with gate for Oniru, Victoria Island. Sey di house get swimming, steady light but Ms. Sophia no accept am.

Instead, she demand sey make him continue to de pay rent of #5mil every year for di rented apartment wey she and de pikin de stay as his own contribution to di daughter accomodation.

Imade and Sophie Momodu

Him no stop there, him say as him de try make sure sey Imade dey alright, “him buy Range Rover SUV for di pikin and respondent make them de carry am for her school runs etc”.

Davido come throwback to last year sey e get one day wey him receive call for Imade school sey she no go school for two weeks. As him ask di mama she tell am sey di Range Rover get issue, but she no gree tell am about di issue.

David add sey as him de try make everything get for Imade, him sharperly send another Highlander SUV with additional #5.8mil as di mama demand make dem use fix di Range Rover, which make am two SUV wey dey di mama hand.

“Him also de pay di nanny wey de take care of Imade, him de pay hospital bills and insurance and other abroad waka wey Di pikin de go.

Sey even as him de try, di respondent dey try frustrate him efforts with plenty demands wey no too make sense. One of di demands na set make “him de pay di nanny $800/month and $19,600/year.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *