#CHIVIDO2024: Davido set to wed Chioma

#CHIVIDO2024: Davido set to wed Chioma

Few days after him carry him first baby mama Sophia Momodu go court, singer Davido dey set to marry Chioma.

Their relationship wey don dey reach seven years don finally don as the two lovers release their pre-wedding pictures for Instagram with the tag #CHIVIDO2024.

This wedding na talk of di town because many influential people for di country go attend am. And even those wey no dey influential de find how them go take attend Di wedding go pick money.

To start di wedding proper, videos for di bridal shower of Chioma who them de call Chef Chi, don already comot for internet. Inside di video, e show as Davido de follow him wife to be dance to set Di celebration mood.

#CHIVIDO2024: Davido set to wed Chioma

Sophia Momodu release official statement amidst Chivido2024 wedding preparations

While everybody de happy sey 001 and 002 don finally de tie di knots, Davido first baby mama Sophia Momodu drop small bomb sey na official statement.

This official statement to to clear di air about the things wey Davido tok for him lawsuit.

One of the things wey she tok be sey, she been dey relationship with the singer for 2012-2014 which them born pikin from am. Later on, them still do another relationship for 2020-2022.

She tok sey wetin David tok no be true completely, sey she no prevent am from seeing their pikin but na him decide sey him no go see the pikin again by himself since July 2022.

#CHIVIDO2024: Davido set to wed Chioma

And Di reason na because she no give am her body again. Sey since that time wey she refuse sey make him no touch her, him stop to de pay their rent, di pikin school fees, medicals and other expenses. Sey, e get one time wey na di Singer Papa, Mr. Adedeji Adeleke naim clear di pikin school fees.

Sey not only di school fees but Davido don cut off him pikin, sey him no de reach out to her even on her birthday and the girl don de ask wetin happen wey her papa no de talk to am again.

#CHIVIDO2024: Davido set to wed Chioma

She come conclude sey since di matter don enter court hand, she dey ready to cooperate with then so that them go solve di issue.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *