Deputy Commissioner of police, DCP die for headquarters

Deputy commissioner of police (DCP)

One Deputy Commissioner of Police, DCP Abubakar Mohammed Guri, for COMPOL MOPOL, Force Headquarters, Abuja collapse and die on Monday 3rd June.

Dem talk say di late DCP wey dey wear him uniform, fall for him chair for him office.

Dem rush am go Clinic wey dey inside Police headquarters for medical help, na there dem confirm say e don die.

Dem never give any real reason why di officer die, dem talk say him look strong that morning and greet officers and staff for Mopol department when him come work.

However, one person wey talk for secret, talk say e fit be say di senior officer faint and die because of heart failure. E talk say recently, many police officers don dey suffer same wahala because dem dey work tire-tire, even for night, without rest.

Nothing come out from di office of di Force Public Relations Officer about di late officer.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *