Early Saturday morning wey be June 8th, 2024, pipo wey de work for Economic and Financial Crimes Commission arrest 127 yahoo boys suspects for club wey them go for “Yahoo party” in Akure.
Wetin EFCC tok be sey them bin get OT sey di party suppose happen since on Wednesday, June 5, 2024. But di boys shift am go Saturday sake of them wan dodge from di security and intelligence networks. Inside di statement wey them release, EFCC tok sey,
Members of Ibadan Zonal Directorate wey be part of EFCC don arrest 127 yahoo boys suspects for early momo operation wey them comot. Di arrest happen for wetin dem call “Yahoo party” wey happen for Signature and Abah clubs Akure.
Di statement also tok sey dem gather some items like tush cars, laptops motorcycle, wristwatches and documents wey go help di investigation.
Items wey dem gather na tush cars, phones, laptops, motorcycle, wristwatches and some other documents wey dey like exhibit. Na so di statement tok.
EFCC come tok sey them go charge di 127 yahoo boys suspects to court immediately dem finish di investigation.
Nigerians React To Arrest By EFCC In Akure
After di arrest wey happen for Akure, e come trigger some reactions from naija pipo and dem come chook mouth for di matter as e de do them for bodi.
Many Nigerians for X come de trend di matter de tok sey, why dem no de pursue pipo wey dey for government like Yahaya Bello and co?
Some tok sey even di EFCC de work for their belle and na food dem de find for di yahoo boys hand.
Since this 2024 start, dem don arrest plenty boys wey dem tag yahoo boys, and Di reason na to reduce the rate of internet fraud wey de happen.