Di Economic and Financial Crimes Commission EFCC, don promise to review di reports about di recent auction for vehicles wey them seize.
This pledge come shortly after many people complain about di glitches wey them experience for di website.
Some of di issues wey di commission receive na website accessibility, some participants being shut out after placing bids and inflated prices.
While trying to address di matter, EFCC spokesperson, Dele Oyewale give statement on Thursday, January 30, 2025 sey, “Di complaints arising from di exercise dey unfortunate. Di online auction platform was intended to ensure seamless and transparent participation, but some changes like over four million participants and unstable network affect di process”.
EFCC Blames Poor Internet, High Turnout Of Nigerians For Glitches In Car Auction Process pic.twitter.com/RonbLnVfo6
— Instablog9ja (@instablog9ja) January 30, 2025
Oyewale talk sey di commission try their best to monitor di exercise wey take place between January 20 and 27, 2025, and them confirm sey truly some mistakes happen.
Him assure di public sey them don communicate di issues to di right people wey dey in charge of di process make them correct am.
“Di EFCC dey acknowledge di reported issues and experiences of some Nigerians wey participate for di just concluded public auction of seized vehicles conducted by accredited auctioneers on behalf of di commission.
Among di complaints wey di commission receive, na inability of some citizens to access di website of di auctioneerd, being shut out from di platforms after submitting buds and outrageous bid prices, among others”. Oyewale said.
EFCC distances itself from auction processes
While them acknowledge di complaints wey people give, di EFCC don clear di air sey even as them follow monitor di auctioning, them no fit directly chook mouth for di auction because them don already assign some licensed auctioneers and na according to “Section 4(a)(b) of di Proceeds of Crime (Recovery and Management) Act, 2022” and Section 55 of di Public Procurement Act, 2007”.
Di commission go ahead to assure di public sey once then get report from di auctioneers, then go review di complaints to ensure sey ojoro no dey.
“Without making excuses for di auctioneers, e dey possible sey di number of participants (over four million) been stretch di capacity of di online facilities of di auctioneers, also bad internet for some parts of di country contribute.
Right now di commission dey wait for report from di auctioneers and we de assure sey we go review genuine complaints from members of di public to ensure sey nobody feel cheated”.