Drama breakout for social media as members of ANIF for Equatorial Guinea arrest Mr. Baltasar Egonga for the sextape with 400 women wey leak.
According to news wey dey ground, Mr Egonga been dey sleep with over 400 women of different class, including him brother wife, him cousin and wives of other top officials for di country, including the president wife and 20 other Minister’s wives.
Who is Baltasar Egonga?
Mr. Baltasar Egonga na di Director General National Financial Investigation Agency for Equatorial Guinea. Before di sextape saga, officials of ANIF been de investigate am based on one fraud wey him fit dey involved.
During di investigation, di ANIF officials lap him house without any notice de search am. Na in di process of searching naim them discover some CDs wey contain sextape of nearly 400 women wey him been don knack including him president wife.
Lady Commits Suicide Over Sextape
As them de dig di matter dey go, Mr Egonga talk sey him no force anybody,all di women sabi sey him record them.
Mr. Egonga na married man with six children and na top official for him home country for guinea.
After them arrest am, rumours comot sey one of di women wey dey di sextape don kpai herself because she no fit take di shame.