Inside one video wey dey trend for X, police officers find five young boys wey don kpai for inside one apartment for Auchi.
According to reports wey people dey give, one young man and him four friends don lose their lives to plate of pepper soup wey ex girlfriend prepare.
Inside the video with no sound, e show as some police officers enter one apartment to see some young boys for ground like sey them de sleep. Only sey, these boys don already die for the apartment.
Them never reveal the identity of the boys or the particular boy wey the girl visit, but then don identify the girl name as Peculiar.
Five Friends Die from Ex-Girlfriend Pepper Soup Poisoning
In the video wey don gain many social media reactions, the five friends de put on boxers to show sey them de relax for house. Two of the boys dey for ground for the passage, while three dey for the bed as them take kpai.
Some social media people claim sey the boy been get accident and na why the ex girlfriend decide to visit am.
As she visit, she prepare catfish pepper soup for the ex boyfriend which him friends join am chop.
This girl po!soned her ex boyfriend by putting po!son in pepper soup, but four of his friends ended up eating it with him.
Sadly, her Ex and his friends are unalive.
This young girl k!lled 5 persons.
There are reasons why people avoid their Exs…
This girl is brutaI ooo pic.twitter.com/LDi6czH7Bt
— LILI BABY 🙈 (@LisaNwabia) October 31, 2024
Backstory of the Event
According to the gist, this sad event happen on Saturday 26th October for Auchi, Edo State.
Based on tori wey dey ground, Peculiar na ex girlfriend to one of the five boys wey don kpai. She and the boyfriend been breakup and as the breakup pain her, she decide revenge.
She cook catfish pepper soup go give the ex. Without knowing the ex chop am with four of him friends. Na wetin lead to their death be that.
Since di matter comot, no security official don release statement yet, but di girl still dey with Nigerian Army.