Find out why Dangote fuel has clear colour

Dangote fuel has clear colour

As many Nigerians don sabi sey Dangote refinery de produce fuel, different reactions follow the announcement because Dangote fuel colour dey different.

Some people dey happy sey now we no go de import fuel again. But based on sey this fuel no dey like the normal fuel wey we dey see every day wey dey yellow like piss, people come dey ask why Dangote fuel dey white like water.

For this article we go explain why Dangote fuel pure like water and how e take different from other fuels.

Why Dangote fuel has clear colour

Wetin dey give fuel yellowish colour na if sulphur dey inside but Dangote fuel no contain sulphur naim make e dey very clear without any colour.

Na ethanol them use add to do Dangote fuel. And when them use ethanol make fuel, e dey get enough oxygen which go reduce the amount of carbonation wey dey happen inside engine.

Once the carbonation don reduce, e dey reduce air pollution. This one mean sey the fuel dey very good for car engines and the environment.

What determines the Dangote fuel colour?

Petrol dey get different colours and e get why.

Based on the different things wey them dey add during the manufacturing process, fuel fit look red, yellow, green or white.

  • If e dey like red, e mean sey them add octane inside.
  • If e dey like green e mean sey the octane wey dey inside plenty.
  • When e dey yellow, e mean sey lead no dey am.
  • When e dey clear like Dangote fuel dey, e mean sey sulphur no dey and na ethanol them use make am.

Ethanol dey help person car run well which go help the car last.

 

Emmanuella Koughna

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *