On Tuesday June 25 wey #CHIVIDO trend, Di former Chief Executive Officer (CEO) of KONGA been commit suicide for him Lekki apartment in Lagos State.
Mr. Nick Imudia wey been serve as di CEO of KONGA leave him family and friends speechless as him jump from di balcony of him Lekki house on Tuesday afternoon.
BREAKING NEWS: Former CEO of Konga, Nick Imudia takes his own life. 💔 pic.twitter.com/4J7B7xnvFy
— Nigeria Stories (@NigeriaStories) June 26, 2024
KONGA where Imudia served as di Oga before him death na one of di e-commerce giants for Nigeria.
Before him jump, him call him brother wey dey US give am directions of how him go take share him property and money in case anything happen to am.
Him also call him daughter wey him been born for him first marriage wey crash. Him tell di daughter sey him go always get her back, and anytime wey she need him help, make she look for sky sey she go see am.
Mr. Imudia wey hail from Ika South Local Government Area of Delta State no only work with KONGA, him been work with TCL/Alcatel as dia regional manager, and Microsoft Device and Services as dia GM/MD under West and Central Africa.
Many people don talk say depression fit be the reason why the man take him life unexpectedly like that.