JAMB Releases Supplementary Results

JAMB image

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), don release second results as di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) supplementary results.

Them write this supplementary UTME on Friday June 21 and Saturday June 22 2024.

The man wey de tok on behalf of JAMB as di spokesman, Fabian Benjamin don direct all di candidates on how dem go take check their results.

To check results, candidates go send UTMERESULT as text to 55019 or 66019 with di same phone number wey dem take generate their profile codes when dem been first register.

Benjamin tok sey na 28,835 candidates sit for this supplementary exams. And na because during that first time, dem been no fit do their biometric verification for the main 2024 UTME.

Also those candidates wey dem suspect for malpractice follow write this supplementary UTME because dem get second chance.

The exam been dey successful because of di tight security wey di board provide and even people wey try impersonate some candidates dey with law enforcement agencies for proper investigation.

The board go continue to make sure sey dem go use correct correct technology so that candidates no go fit cheat for exams.

Dem dey encourage candidates sey for their own good, make dem comot hand for anything malpractice. And make dem stop to dey pay yahoo boys money wey dey promise to increase their scores since na fake scores dem go get las las. 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *