One year after di death of di CEO of Access Holdings, Dr.Herbert Wigwe,kasala don burst for di properties wey him leave behind.
According to sources,him extended family of siblings, cousins and parents don de fight him immediate family because of properties.
Di late billionaire meet him tragic end in one plane crash wey claim him life, him wife and their son life. Ever since their demise, different stories don comot based on inheritance rights.
One of di stories na the one wey comot last year October, wey talk sey Pastor Shyngle Wigwe, one relative to di late billionaire been de attempt to change di late banker’s will to disinherit him children.
New legal documents reveal legal battle between the Wigwe’s over inheritance rights
After di news comot, di family been try deny di claims sey them don withdraw di suit as them de only try protect di children wey Herbert leave behind.
Shortly after their denial Christian Chukwuka Wigwe, a cousin to di late Herbert been file petition to contest di validity of di will. According to Chukwuka, him been de act on behalf of Pastor Shyngle Wigwe.
After Chukwuka’s claims enter public space, people come de wonder whether them truly withdraw di lawsuit.
Additionally, more legal documents don find their way enter public space and from the look of things, di family no withdraw di lawsuit wey include late Hebert’s daughter Otutochi Channel Wigwe, Uche Wigwe and Aigboje Aig-Imoukhuede.