Academic Staff Union of Universities, ASUU don give federal government last warning, Sey if them no settle the issues wey them get, kasala go burst.
Mr. Emmanuel Osodeke wey be ASUU president release this statement on Wednesday, September 25, 2024.
Mr. Osedeke talk sey federal government don use style delay wetin them promise to do and them (ASUU) don frustrate.
Therefore, them de give president Bola Tinubu government 14 days which don already start since Monday, September 23, 2024.
ASUU threatens fresh strike. Gives federal government 14 days ultimatum to address pending issues pic.twitter.com/8WySKQ6pya
— Tunny🔥 (@Tunex01) September 25, 2024
Inside the statement wey him drop, e talk sey “Based on matters wey don already dey ground, ASUU don decide give Nigerian government additional 14 days join the 21 days ultimatum. And this ultimatum start since Monday, September 23, 2024.
During this period, make federal government try reason the matters make e favour the Union too.
And if federal government decide fail them, them ASUU no mind to go aura for aura with the government. And make nobody hold them responsible if other issues later sup”.