Meaning of “chop breakfast”

That you dey whine me face

The slang “chop breakfast” don dey popular for Nigeria for some years now and pipo dey always use am for conversation.

Chop breakfast na one of di popular Nigerian slangs but this one explain say pesin collect heartbreak from breakup for relationship.

Dem fit still use am to take describe say dem dump pesin or dem disappoint pesin.

Chop breakfast na phrase wey we fit use for many ways. For example if pesin partner breakup with am, e mean say he don chop breakfast.

If dem sack pesin for work, na still to chop breakfast be that.

Na according to how pesin behave him go chop breakfast. So observe your doings make you no chop breakfast.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *