Meaning of Gbas Gbos

Esther-Blish Faji

E sure me sey e don tey wen you begin de see this gbas gbos for social media, and maybe you don even de think of the meaning once once.

As many other slangs de trend for Naija, an so this gbas gbos trend take start. As e be now the top Nigerian slangs wey de trend na “warm eba chop”, “dey play” and maintaining “steeze”.

Even as this gbas gbos don de trend for sometime now, no be many people sabi wetin e really mean. If you be one of the people wey de wonder the meaning of gbas gbos, we go help you break am down to very simple something wey you go grab.

Meaning of Gbas Gbos

The meaning of gbas gbos no too deep as you go think am. And if you reason am well, the meaning dey like the sound gbas gbos .

But to help the confusion of many people wey need extra shalaye, gbas gbos na slang wey de talk about fight or vawulence.

For example, if you de quarrel with person, you talk your own and them follow talk their own, you don give your gbas and them don give you their own gbos.

Another example na the Davido and Sophia Momodu saga wey happen last month. Davido give him gbas and Sophie give her own gbos.

Another example na

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *