Meaning of Gbese

Adam go stain your white

Gbese na slang wey don too tey for Naija people hand. Even people wey no be Nigerians suppose don here “Gbese” one or two times.

But wetin truly be the meaning of Gbese wey we don de talk about since?

Gbese na another Nigerian slang wey come from Yoruba people and e get two meanings depending on how you use am.

Meaning one: the first meaning of Gbese na trouble. You fit still talk sey na another name for wahala.

Meaning two: the second meaning of Gbese na to borrow money.

The two meanings take relate somehow but them no be the same thing.

For example, you fit dey inside Gbese make you no de owe person money. One good example na when Bobrisky abuse Naira for the party wey him attend. As him abuse the naira, him enter Gbese na why them arrest am.

Another good example na how Nigeria dey always borrow money from China. That one now mean sey, Nigeria get gbese wey him supposed pay.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *