Meaning of “Just dey play”

just dey play sign ICYMI

Nobody take sabi how trends and slangs de start for Naija, but na every day we de hear new slangs. One popular slang na “Just dey play.”

This slang don de trend since this year begin just like “No gree for anybody”. But some people just de use am and them no sabi wetin e truly mean.

The meaning of “Just dey play” dey very simple and na one of the simplest naija slangs be that. Just dey play get as e take sound like threat somehow but no be threat but street advise.

Just dey play na Naija people way of telling person sey the person de deceive himself. For instance as Nigerians don plan this 1st August Protest, the government com out tell them sey “Just dey play”.

That one mean sey Nigerian youths just dey deceive themselves and nothing fit sup, but Nigerians don make up dia minds say dem must go on with di protest waka.

 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *