Meaning of Tuama

The Kid has Tuama

Tuama na one among di Nigerian slangs for 2024. Na street language wey Nigerians don adopt am. As many people de use am, e good to understand wetin e mean and  how to use am well.

Meaning of Tuama

Tuama means to run away or to disappear. If person talk sey him wan Tuama, e mean sey him wan leave that place ASAP.

Di real origin of Tuama no too clear because, e just start to trend, but Nigerians don adopt am as one of the 2024 slangs wey comot.

Social Media Usage of Tuama

Them de use Tuama to narrate when person don run or varnish, especially of di person get gbese or kasala don burst for e head.

Example :

“The person wey dey hold Ajo money don Tuama”.

This one mean sey di person wey de hold contribution money don run with di money.

Another example:

“Some yahoo boys Tuama when them see police “.

This one mean sey, di yahoo boys run when them sight police.

Synonyms of Tuama

Just like every normal Nigerian slang, Tuama get other words wey nearly get the same meaning with am. Some of the words na:

1.Japa/jakpa

Japa na slang wey mean sey to run or to migrate.

2.Mya

Mya and Tuama na both new trends wey comot for inside 2024. And then mean the same thing. Mya meaning na to leave.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *