A Magistrate Court in Sabo, Yaba, Lagos sitting on Tuesday, February 25, 2025 handling di case of late Ilerioluwa Aloba also know as Mohbad been invite Abdulazeez Fashola otherwise known as Naira Marley and other names wey dey related to di case.
Channels Television been report sey di Magistrate in charge of di case, Magistrate Ejiro Kubenje wey give legal advice issued by di Directorate of Public Prosecution, Lagos talk sey Naira Marley no get any case to answer.
Di Magistrate go ahead to clear other names involved like show promoter, Samson Balogun alias Sam Larry; Owodunni Ibrahim alias Primeboy; and Mohbad’s former manager, Opere Babtunde.
Court clears Naira Marley, Sam Larry, Primeboy as nurse faces trial over Mohbad’s dëath. pic.twitter.com/3S1L4KrF74
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) February 25, 2025
Auxiliary Nurse to face prosecution over Mohbad’s death
After clearing some of di names linked to di death of Mohbad, di DPP don talk sey them go continue to prosecute di auxiliary nurse wey been trrat Mohbad, Feyisayo Ogedengbe alongside one of Mohbad’s friends, Ayobami Sadiq.
Di reason for di prosecution na reckless and negligent acts wey dey contrary to Section 251 (e) of di Criminal Law, Ch C. 17, Vol. 3, Laws of Lagos State, 2015.
This news dey come few hours after di late Mohbad’s wife, Omowunmi talk sey she go do DNA of her pikin with di late singer, Liam, not because of her father in-law, Mr. Aloba, but just to clear di air.
During an interview with BBC pidgin, Omowunmi talk sey Mr. Aloba dey “100% sure “ sey Liam na him grandson. Omowunmi go ahead to share her difficulty since she lose her husband and how much she miss am.