Di Speaker of the House of Representatives wey be Rt. Hon. Tajudeen Abbas don appeal to di planners of the nationwide protest for August 1st, say to build the country na everybody task as organisers dey serious to carry out the waka.
For story wey we see for Channelstv website, Musa Krishi wey be Special Adviser for Media and Publicity naim sign the tok wey Speaker House of Reps yarn.
Shelve Your Action In Nigeria’s Interest, Speaker Abbas Begs Protest Organisershttps://t.co/WeTfyb5ejW pic.twitter.com/SkTaZz8oYO
— Channels Television (@channelstv) July 30, 2024
Wetin House of Reps Speaker Tajudeen Abbas tok
“Speaker Abbas don see say una, especially the youths, dey vex and worry. E say government wey President Tinubu dey lead no go stop to try help Nigerians.
Speaker talk say House of Reps don dey do tins wey go make dem dey hear una wahala and wetin una wan, make dem fit solve am.”
How Speaker Abbas address protest organisers
“I dey talk to una today with pity for una and I wan do my work well well. We dey inside hard time now, and I know say many of una, especially the youths, dey suffer. The economy dey hard, life no easy, and other wahala dey worry our country.
“Una vex and una no sure say tins go better, we don hear una. We know say una dey cry say make tins change, make Nigeria become better place wey everybody go dey chop equal. Make una know say government wey President Bola Tinubu dey lead, dey take una matter serious.
“We wan dey listen to una, talk with una, and work with una make we find solution to the problem wey dey face us.
Government don start some tin wey go help una youths and make una happy. One of dem na student loan, make e easy for una go school, make any youth wey wan go school fit go.
“Government wey Tinubu dey lead don do plenty tin make young people fit get money start business. Na like dat Consumer Credit Scheme be, wey go help una start una own tin. We dey try make work dey for people and teach people work. We dey try make una youths no just dey find work, but make una dey create work.
“House of Reps dey try do im own part too. We dey make plan to dey talk with una youths always. We know say una voice important and we dey create place wey we go dey talk together make we know wetin go do.
“Make una know say to build country na work wey everybody go do. Make we stop fight-fight, make we dey talk. Una get right to protest, we know say na true.
“Make we use good way talk our mind and work together make we solve problem.
I dey beg una wey dey plan protest make una stop am for country sake. Make una give government time. Make we talk together. Like I don talk before, government don dey do some tin to stop the problem.
“To finish the matter, I wan talk say House of Reps go dey with una, go work with una, make una future bright.”