LIVE UPDATES: Nigerians hold nationwide protest on 1st August

August 1 protest across Nigeria

Chants for protest dey very high now as things don too choke for Nigerians and dem don decide sey enough is enough.

As e be so, Nigerians don attend di nationwide protest today wey be August 1 and e dey trend for X (Twitter).

This nationwide protest na something wey Nigerian youths don plan since June sey things don too cost and common man no fit survive for this economy. And on top of that, sey politicians de use money anyhow and them no send anybody papa.

Why Nigerians dey protest on August 1

Based on wetin dey internet, some of the things wey the youths de demand for be sey:

  • Make them take fuel back to #100/litre
  • Make government fight insecurity and hunger wey dey di country.
  • Make them flush people wey de do elections and look into the ₦355billion budget.
  • Make them release all ENDSARS protesters wey them arrest since 2020.
  • Make them carry minimum wage go ₦300,000.
  • Make Primary and Secondary Schools dey free and make them give grant for University.
  • Make politicians children de go public schools.
  • Make government de patronize made in Nigeria products.

Dis protest wey Nigerian youths take time plan de come after Kenyan youths do their own protest wey later turn to fight with their government.

Nigerian youths come de shame for themselves sey a whole giant of Africa no fit gather the kind courage wey Kenyan youths gather the fight their government. Sey them sef make them follow protest for better government.

Government don comot beg youths sey make them no protest, sey them know sey as citizens, the youths get rights to protest. But make them no protest sey if them protest and the thing come lead to fight sey things fit sup.

But from the look of things, Nigerians no listen to government wey tell dem not to go on with di planned protest.

Dis na sightings from various cities for the country wey youths don gather for the protest.

Port Harcourt

In the city of Port Harcourt, protesters gather for Pleasure Park.

Abuja

In the nation’s capital, plenty people dey for Eagles Square and many other areas dey do the protest.

Lagos

In Lagos State, protesters gather for Ikeja and various sections of the state as situation dey bite everybody.

Kano

Di ancient city of Kano, pipo gather dey show their grievance for government body. As e be, nobody dey smile for the country.

Owerri

Even for Owerri wey dey Imo State, you go see plenty people don gather for the protest. Everywhere dey heat up for the matter.

Network failure grips protesters on August 1

As many Nigerians don go outside to show their annoyance on how things dey be for di country today wey be August 1, telephone network come dey disturb.

Di situation dey very serious, pipo come dey yarn say, government and MTN especially, don do arrangement to disorganise internet connectivity for them.

For social media, plenty plenty talk dey ground already, blaming government interference for the matter.

But as e be so, the network no fit stop protesters wey dey for streets already in all major cities of the country.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *