Reactions trail Nicki Minaj’s Pidgin Language Tweet

Music stars Burna Boy and Nicki Minaj

Onika Maraj a.k.a. Nicki Minaj wey be rapper for New York don spark reactions for social media as she don dey throw small small pidgin language put for her recent tweets. She first use am when she reply one guy wey post false news about am.

After this one, she don still use pidgin for the tweets wey she later post.
For one of do tweets, she reveal say she fit read all di pidgin language wey people dey post.

For another tweet, she don still dey use some Nigerian pidgin slangs take express herself.

This one don spark plenty reactions, especially from Nigerians. Many people just dey confuse. Some dey wonder who dey teach oyigbo pesin pidgin language. Some day na Davido wey dey gum body with am collect her phone take type am. Some don even remix her name join with Nigerian name like, Oluwanika, Chukwuminaj, etc.

Read some of the reactions under the tweets below:

Nicki Minaj tweets don reflect di beauty of Nigerian pidgin. Some things just dey make sense to express for pidgin language pass normal English and na wetin Nicki Minaj tweets don prove. As she use slangs like “abeg”, “walahi”, and “wetin“, e add beauty to wetin she dey try express.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *