Nigeria embraces cleaner energy: CNG takes the stage

CNG the way forward for Nigerians

Naija dey try make CNG (Compressed Natural Gas) as new fuel, instead of petrol wey dem dey import.

Dis one go help reduce pollution, make Naija use im own gas wey plenty, and save money even as the T-Pain era dey bite us.

Toeing the way of CNG

1.⁠ ⁠CNG Price: Govt say dem go sell CNG for 200 naira per liter, wey small pass petrol price wey be 1400 naira.

2.⁠ ⁠Infrastructure: Govt dey build new gas stations, and convert old petrol stations to CNG.

3.⁠ ⁠Incentives: Govt dey give free money, tax break, and low-interest loan to people wey wan change to CNG.

4.⁠ ⁠Vehicle Conversion: NADDC start program to change 50,000 vehicles to CNG.

5.⁠ ⁠Private Sector Dey Help: Big oil companies like NNPC, Total, and Shell dey invest for CNG.

Why CNG is good

1.⁠ ⁠No Pollution: CNG reduce pollution by 70%, and particulate matter by 90%.

2.⁠ ⁠Save Money: CNG cheap pass petrol, save people 40%.

3.⁠ ⁠Energy Security: Naija get plenty gas, so CNG no go finish.

4.⁠ ⁠Create Job: CNG go create thousands of jobs.

Wetin Dey Block Am:

1.⁠ ⁠Infrastructure No Complete: Naija need invest for CNG infrastructure.

2.⁠ ⁠People No Sabi: People no know about CNG benefits and safety.

3.⁠ ⁠Law No Strong: Govt need strengthen law for CNG production, distribution, and use.

Conclusion:

Naija dey move to clean energy, CNG dey take over. Govt, private sector, and people need work together make am work.

Clement Christopher

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *