Di organisation wey dey incharge of all di workers for di country, wey dem de call Nigerian Labour Congress (NLC) don commence di indefinite strike wey dem promise yesterday Sunday o.
And as them start di strike, Trade Union Congress (TUC) and other important organisation don de join di strike.
This strike come after one meeting wey NLC and TUC bin get with members of di National Assembly on Sunday for Abuja, di Nigerian Capital. But before dem sit for di meeting, NLC don already give warning since Friday wey be last day of May.
Other top organisations for di country like Transmission Company don already tok sey dem sef don follow for di strike as dem don already shutdown di National grid wey de supply electricity to di country. And some part of di country don de feel am already.
Wetin Cause Di NLC Indefinite Strike?
On Sunday wey be June 2, some pipo wey be part of National Assembly meet with pipo from NLC and TUC to settle di strike matter wey them bin threaten.
This meeting wey last for four hours no give any head way as di TUC chairman comot tell journalist sey di strike go stin hold.
The koko be sey, wetin truly cause all this kasala na sake of sey, Federal Government no gree put body for di minimum wage demands wey NLC set.
TUC chairman Festus Osifo tok sey
” We still maintain sey since we no fit find common ground with federal government based on di minimum wage demands, them stin Neva reverse di hike in electricity tariff and them still categorise people into bands, based on every every, Nigerian workers dey forced to go on indefinite strike wey go send message to di federal government based on di demands, and this strike go start on June 3 wey be Monday. ”
Di minimum wage wey NLC and TUC dem de demand for na #494,000 based on sey tins hard wella for di country but federal government tok sey na #60,000 highest them fit pay.
Minister of information and National orientation, Mohammed Idris tok sey that #494, 000 no dey sustainable,sey di amount fit scata di country economy.Na where we dey so, as nobody wan gree for di other, strike don start.