Naija man dey shock, see gorillas dem name “Ngozi” and “Nneka” for zoo wey dey Canada

Nneka and Ngozi: Canadian gorillas

One Nigerian man don cause commotion for online after him see gorillas wit Nigerian names, “Ngozi” and “Nneka”, for one zoo in Canada.

Him dey show for one video, wit him face for plane, just before him reach di zoo. Di video get caption wey confirm say di place na zoo for Canada.

When him reach di zoo, him shock to see di Nigerian names dem give to some of di animals, especially di two gorillas wey dem name “Ngozi” and “Nneka”.

After dem post di video, many people come dey comment section to share dem opinion. Some dey laugh, some dey surprise, and some dey happy to see di Nigerian culture dey represented for di zoo.

Clement Christopher

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *