We know say fans go like to know wetin Olamide net worth be and try to compare am to other artists for the country.
Born Gbenga Adedeji alias Olamide Baddo, the guy na top Nigerian rapper and songwriter wey don dey for music industry since 2010.
Since him enter the music game, home popularity and influence continue to grow, and him don touch people lives in different ways.
As the matter dey always be, some of him fans go de wonder wetin be Olamide net worth for 2024.
the most impactful artist of his generation — Olamide Baddo.pic.twitter.com/nHSULeJwBR
— 𝑺 𝑵 𝑬 𝑯 ➐ (@SnehQueenBee) October 12, 2024
Olamide Profile
Olamide Adedeji AKA baddo or Young erikina na Nigerian musician wey enjoy to use him native language (Yoruba) sing songs. Na for Bariga in Lagos state them born baddo, on March 15, 1989 for Bariga, Lagos (35 years).
Him start him musical career for 2010 with him first single “Eni Duro”. After him start to gain popularity, him come start him own record label Yahoo Boys No Laptop (YBNL) which still de stand till date.
Before him start to singe, Baddo been de study mass communication for Tai Solarin University, but because of money issues him later dropout fro school to pursue him dreams.
Olamide Net Worth in 2024
Based on sey him don dey de industry for some time, Olamide don make name for himself wey dey very popular for even outside the country.
As time don pass, him don gain popularity among upcoming Oduduwa indigenous rappers as their mentor. Added to him popularity na the rabas wey gum him name.
By estimation, Olamide net worth for the year 2024 dey within the range of $35 million. But as them de talk sey nobody fit sabi pass wetin their eyes see, him fit get more wey we no sabi because him get other businesses wey de give am money as well.