One dead as Journalists are kidnapped enroute to cover Super Eagles game

Super Eagles team

Kidnapping story wey come out wey concern the Super Eagles match that was played on Friday no sweet at all.

For tweet wey Oganla wey be well-known Journalist for Nigeria make, him narrate how them kidnap some of him colleagues wey be crew members wey suppose cover the Nigeria Vs. Libya match.

Inside the tweet wey him make, him talk sey, normally these people dey fly go do job, but as things take cost this T-pain era, flight ticket sef go up, na why them decide travel by road.

@ogaNlaMedia talk how inside the people wey them kidnap, one particular journalist don kpai. And this journalist naim cover the #BBNaija finale for Sunday.

Sey, security operatives don try rescue some people wey them kidnap, but two other people still the miss.

Yesterday them kidnap TV crew wey de broadcast Nigeria Vs. Libya game for Uyo. In the process, one colleague and na him be the camera 1. 

Na this same man be part of the people wey produce #BBNaija final on Sunday. Security operatives been rescue some of them but two other people still dey miss“.

@ogaNlaMedia continue to rant sey Nigeria don happen to him colleagues and e dey pain am well well. Sey before e no de take more than #100,000 to go Uyo come back, but now only one person ticket go cost more than #300,000.

Before him finish, him talk sey him de pray for the country sey, make fuel prices dey affordable and make road sef dey safe for people. Sey make flight ticket dey affordable and make food no pass person to buy.

Emmanuella Koughna

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *