Slangs na some kind play play words wey we dey use for our everyday talk. E no dey fit for official use. Slangs fit enter from popular trends, and e fit change as time dey pass.
For Nigeria, slangs don become normal thing and it is already part of di culture. Slangs fit even popular pass normal language as new new ones dey come out every year.
Many slangs don dey popular for Nigeria. For this article, we go talk about di slangs wey popular pass for Nigeria and wetin them mean, with examples.
Nigerian slangs and dia meaning
1. Japa: Dis na popular Nigerian slang wey mean to run away, escape, or to quick comot, especially from wahala or difficult situation. E come from Yoruba language. For example, if police show for party and person no wan enter wahala, e go japa from the place. Japa fit also apply to other serious situations, like when person dey find better opportunities abroad and dem wan comot for the country. For this kind situation, japa go mean to change location go another place.
I prayed and waited for Jehovah to act and He listened! I don japa o! To a new beginning!🙏🏿 pic.twitter.com/v0I252gVbU
— StephofManchester (@Steph1ofLagos) October 23, 2022
Examples of Japa inside Sentence
-
- As dem start to dey fight, I just japa from there.
- Once e hear say na him turn to pay, e japa.
- This country hard, I need to japa go abroad.
2. Steeze: Steeze for Nigeria mean say person get natural style and swag. E dey talk about person wey dey dress well, carry body with confidence, or get cool vibe wey no dey hard.
Example of Steeze inside senteence:
-
- If you see person wey dey dress sharp and get swag, you fit talk say, “That guy get steeze,” meaning say That guy style and him swag make sense.
- ”Omo, your steeze na die!” E mean say the pesin no dey force di vibe but him personal style make sense
- ”Your steeze dey burst my brain,” e mean say their style dey blow mind and e dey motivate.
Monday is for Odogwu Steeze pic.twitter.com/w7mzpKRxDz
— Voice of Igbos (@Voiceofigbos) July 22, 2024
3. Dey play: For Nigeria, this one mean say person no dey serious or e dey waste time. This na also how we dey take call person attention say e no serious or to laugh person say make e focus on wetin important.
Dey play fit also mean to laugh person because di person no know wetin e dey do, or di person no dey take opportunities serious.
Usage example:
-
- If person dey joke around instead of to work, you fit tell am, ‘just dey play’ meaning say You just dey joke around
- If person no dey take opportunity serious, you fit tell am, ‘You dey play with your life,’ meaning say ‘You dey waste your chances.
4. E choke: E choke na one of the most popular Nigerian slangs. E mean say something dey make good sense, pass wetin people expect, or dey shocking.
Na Davido, wey be famous Nigerian musician, make the slang popular for social media, and now e don enter everyday language.
Examples of “E choke” inside sentence:
-
- The way she sing, e choke! Meaning say di way she take sing make sense.
- “See as people full for concert, e choke!” Meaning say, people plenty for di concert pass wetin them expect.
- “You hear say he buy new car? E choke!” Meaning say, e dey shoving say he buy new car.
5. Plaster: Plaster na slang wey popular tiktoker Wisdom bring. E mean to gum body. E mean to enter location wey joy dey.
Example of plaster inside sentence
-
- I hear say rice plenty for di party, I plaster there o! Meaning say he go enter disparity because rice plenty for there.
- That guy get money,I go plaster am
As things dey happen everyday and plenty things dey trend for social media for Nigeria, na so so slangs dey come out.
Many slangs go continue to come out and dey popular for Nigeria. E make sense to understand di meaning of dese slangs dem so that you fit use am when you dey talk outside.