Today wey be June 12, 2024, as Nigerians de celebrate democracy day, president Tinubu de trend like water for X.
Di trend wey carry different types of vibes and energy show as Naija pipo de feel about everything wey de sup for di country.
Di main gist wey start di president Tinubu trend be sey, as di president wan climb inside back of truck wey go carry am waka, him come do mistake fall.
That fall wey him fall make pipo resurrect one popular trend that year wey dem de call “Brother Bernard”.
For inside di Brother Bernard trend, e de show as people de fall anyhow, na so dem take use am for our president also.
But this president Tinubu trend get as e be, because no be only di fall make am de trend. Inside one video wey show as di president de wave him pipo, Nigerians come de shout “minimum wage”as him de wave de go.
This minimum wage saga wey even cause small NLC strike on June 3, 2024, don de disturb Di whole country. And as nobody wan gree for di matter, na so di matter take choke.
Plenty pipo for X come de tok about di fall, some de talk sey president get zero composure and steeze, and others de compare am to how naira don fall.