Senate president Godswill Akpabio order senator representing Kogi Central, Senator Natasha Akpoti make she comot from di chamber during one seating of di lawmakers on Wednesday, February 20, 2025.
According to sources, di cause of di heated exchange between di senate president and Akpoti na because of seat rearrangement.
During di meeting, Akpoti notice sey them move her seat to another area, and she refused to go with di new seat arrangement. She insisted went to take the position wey she want.
“I am not afraid of you.” Kogi central Seantor, Natasha tells Godswill Akpabio after ordering her out of the Senate Chamber pic.twitter.com/bH7Xy4ZXRf
— Peter Obi Grassroots Mobilization. (@PO_GrassRootM) February 20, 2025
Later on, di Chief Whip Senator Mohammed Ali Monguno noticed sey Akpoti no comply with di new arrangement, him call di attention of di senate president about di lawmaker’s “improper seating position “.
As senator Monguno dey try call di attention of di senate president, Akpoti start to de speak on top of her voice sey she no dey fear di senate president.
In a clip wey dey go round for social media, e show as dey drama take happen, capturing di moment Akpoti stand up to challenge di senate president.