In one recent video for internet, di senator representing Kogi central, Senator Natasha Akpoti-Uduaghan allege sey di senate president, Godswill Akapbio been try make passes at her.
In an interview with Arise News, Akpoti narrate her ordeal with di senate president dating back to December 8, 2023, a day to her birthday and di birthday of di senate president as di both of them be birthday mates.
Senate president asked that we have quality time at his house – Natasha Akpoti
According to Natasha Akpoti, her issues with di senate president start when she and her husband visit di senate president for him country home for one fun-fair wey di senate president been dey host.
Video: “My issue with Akpabio started on 8th of December, 2023… “My case is a case of a student being punished by a lecturer for refusing to sleep with him.”
~ Senator Natasha Akpoti-Uduaghan reveals on Arise TV Morning Show
pic.twitter.com/tNBninFiDo— Nigeria Stories (@NigeriaStories) February 28, 2025
Natasha allege sey while di senate president been de show her around him mansion, him tell am sey make them de spend quality time together for di house.
“Many people never sabi wetin I want talk, but I go speak my own truth, di senate president fit counter am. Di whole issue start for December 8, 2023, a day to our birthday, me and di senate president because we be birthday mates.
All of us been go to Akwa Ibom because di senate president been de host fun-fair for di stadium. Me, my husband and some other of him close friends, we been first go Ikot-Ekpene before we move to him house for Uyo.
For di house him hold my hand dey show me around my husband been de walk behind us, just di three of us de walk room to room as him de show me di interiors.
I then notice sey him start to Waka fast fast while still holding my hand, my husband been dey behind de receive call hut him dey try catch up.
We reach one particular sitting room and di senate president ask me whether I like di house, I tell yes, di house fine.
He now said “now wey you be senator, I go create time make we spend quality time here”.
Just a week ago di senator been dey involved in a heated exchange with di senate president over seat rearrangement. Di exchange been lead to threatened suspension from di senate president, followed by a suit of N100,000,000 wey Natasha lodge against di senate president over malalignment.
Senate president allegedly makes passes at Natasha Akpoti in his office
Going on, Akpoti link her frequent browls with di senate president to her rejecting his advances. She even compare her ordeal with that of a university student wey dey always fail exams because she refused to sleep with di lecturer.
Akpoti also recall one incident wey involve a motion she been moved on di investigation of di corrupt practices in Ajaokuta Steel company. According to her, Akapbio been reject di motion five times, until di sixth time when di deputy senate president been approved am.
Before di approval, she been visit him office to beg am to approve di motion as suggested by some of her colleagues.
While in his office, Natasha allege sey Akapbio make another sexual pass at her.
“At his office, him talk sey, Natasha, na me be di chief presiding officer of di senate, you fit enjoy a whole lot if you take care of me. I tell am sey I go pretend sey I no hear anything. Him reply sey, “well, di ball dey your court”.
As at di time of reporting this news, Akapbio never make any counterargument to di allegations wey Akpoti don lodge against am.