For inside one letter wey dey internet, South Africa through the Progressive Forces for South Africa talk sey:
“We dey truly excited about di upcoming edition of di biggest event in the pageant industry as di Miss Universe crown na career defining moment for di title holder from different parts of di world.
Even as we dey excited, we dey very concerned about Miss Universe Nigeria Chidinma Adetshina who her mother Anabela Rungo dey involved in identity fraud before them start de competition.
One renowned activist Kwena Molekwa risk her life and the life of her team just so that them go fit gather enough evidence about this particular contestant.
South African public been dey very shock as them hear rumours about identity theft, drug dealing and other crimes connected to di contestant and her family.
Di Department of Human Affairs for South Africa begin investigate di matter. Them come discover sey e fit be true sey di contestant thief her South African identity .
After them share di evidence for X, di Nigerian embassy give di contestant diplomatic passport which help di contestant escape with her mother to join di Miss Universe Nigeria competition”.
South African Court Cancels Chidinma Adetshina’s Identity
On di October 29, Home Affairs for South Africa cancel di identities of Chidinma Adetshina and her mother Anabela Rungo by court order.
After di cancellation, di Progressive Forces for South Africa write di letter to di Miss Universe organizers sey them de appeal on behalf of everyone wey stand for justice.
Sey make di organization reconsider di contestant and if possible, cancel her entry since Miss Universe na brand wey get class, integrity and na fair competition.