WAEC and NECO will not allow students below 18 write exams – Minister Mamman

WAEC and NECO logo

Minister of education, Tahir Mamman don announce sey federal government don release new rules for underage students wey wan write WAEC and NECO.

Him talk sey underage students no fit write West African Senior Secondary School Certificate Examination (WASSCE) otherwise known as WAEC, or Senior School Certificate Examination (SSCE), also known as NECO.

WASSCE and SSCE na exams weyevery secondary school student dey write every year before them go graduate come get admission for higher institution.

For one Sunday programme wey channels television de do every Sunday, Minister talk sey, the policy don already dey ground tey tey,sey no be him start am.

WAEC and NECO Age Limit

Mr. Tahir come talk sey, based on the policy, the age limit wey students go fit write WAEC and NECO na 18 years. And this policy go start to function next year. Only students wey dey 18 years and above go fit write WASSCE and SSCE.

Minister talk sey;

“Na 18 years. Wetin we talk for meeting wey we hold with JAMB for July na to allow this year pass,so that e go serve as notice for parents sey this year don pass, JAMB fit admit people wey never reach 18 years. But starting next year, JAMB go make sure sey, people wey no reach 18 years no go fit enter any university for Nigeria”

 

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *