As many people wey de mine this Tapswap coins don de expect the date wey the coin go launch, Tapswap team for X don reveal the real date wey de coin go launch.
This Tapswap na coin wey many people including Nigerians begin take seriously after the launch of NOT coin. You go see people wey dey different ages like young people and even old people them de tap their phone plenty times the collect coins so that when e launch them too go make money.
But many people come de wonder when be the exact date wey the coin go launch make their tapping no be in vain. As before them talk sey na on the June 12th, many people come happy de expect. But on Tuesday wey be 28th May, team Tapswap post for their X page sey de official launch date for the coin na 1st July 2024.
The team come go further talk sey make miners exercise small patience, sey the real reason wey dem de take their time be sey, dem wan fish out some people wey do mago mago for the mining process.
Why Dem Shift Tapswap Launch Date
Before people bin de expect sey Tapswap go launch on the 12th of June as them talk am early this year, but plenty people wey de mine the coin come confuse as them talk sey them don shift the launch date to 1st July.
Team Tapswap Don explain the reason why them shift this launch date. Them talk sey, as some people de use their hand tap the coins, other people the use bots to help them tap. Sey e no to dey fair sey some people de do genuine work while others the use mago mago. Sey them wan use their time to find those people wey use bot to mine so make people wey de mine chillax small as de date no too far again.