Ultimate Valentine’s Day gift guide for him and her

Valentine's Day Teddy Bear gift for a loved one

Another wahala for relationship people this period na to think of wetin to gift their lovers for Valentine’s Day.

If you be part of di people wey dey crack your head to come up with Valentine’s Day gift ideas for your lover, let us help you with di ultimate valentine’s day gift guide for him and her, wey go help you decide on di best gift to give di love of your life this period.

Gift ideas for him

Year in and out Nigerian men don dey shout sey them no want boxers and singlet again because girls wan choke their life with these gifts items.
No be like other girls wey no get an creativity, spice up your relationship with these awesome gift ideas for that Odogwu silencer wey dey your life.

Valentine's Day
February 14 is celebrated as Valentine’s Day all over the World

Customized perfumes

No be every body sabi sey them fit customize their perfumes but here’s an idea. Reach out to that perfume vendor wey de sell oil perfumes for your contact list, you fit track their location so that you go choose di scent of perfume you want.

Let them mix di perfume according to your preferred scent. Contact a good graphics designer to design a good label with di name of di perfume, you fit name am after your Odogwu silencer too.

ALSO READ| The science of love: What attracts Nigerians to their partners

This one na di kind gift wey go ginger your boyfriend make him go meet your people collect lost be this. For already married couples, e no get how you go gift hubby this gift wey him no go double your allowance for house.

Hair Clipper

Now wey HIV and other infections dey on di rise, gifting your man a good hair clipper will not only make him happy but show that your care about his health.

Running shoes/ Sneakers

Men love good shoes. Be it flats, regular office shoes, running shoes or just pams. The fact sey you think sey he serve good shoe alone go make am dey very happy.

Good Wristwatch

After expensive cars, wetin men no de carry play na quality wristwatches. As we all know, men understand sey time na money, so anything wey go remind them about time dey give them morale.

A good leather wristwatch of his favorite color will keep him loyal to your alone. Unless na Urhobo man you dey date.
Another way to make it more romantic na to engrave him name for di back of di wristwatch so that him go know sey you really think di whole thing through.

Customized Bracelets

A pack of customized bracelets for your man na another gift wey better pass singles and boxers. Nowadays, you fit engrave different romantic write ups for di bracelets like him name and di meaning, or him favorite bible verse or quote.

These gifts may seem small but them go along way to show sey you care about am and you remember di little details about him life.

Bonus
If your man get car and you dey up to di task, you fit gift am 20 litres of fuel or two tires to ease him stress from this economy.

Gift ideas for her

As much as e be like sey e dey easy to gift women, sometimes coming up with di perfect gift for your special girl na another work on e own. Na why we compile these cute gift ideas for your woman.

A classy High-heeled Sandals

Sabi girls love classy shoes especially quality ones. A beautiful shoe alongside a handwritten love note to remind her why she’s the best woman in the whole world.

Money bouquet

You may be thinking that money bouquet is out of fashion but no, in fact, it may never go out of fashion as long as women exist. Women love money, money loves women, if you love your woman, give her money, plenty money. And maybe a hand written note.

10 reasons why

You can customize a calendar of 10 reasons why you love her, with each reason having a unique theme and colour to enhance her mood. To be extra, you can make it a 31 reasons why for each day of di month so that she go dey remind herself all through di year how much she means to you.

A date night

If your woman is a hopeless romantic, best believe that all it’ll take to keep her grinning from ear to ear is a private dinner at a luxurious restaurant with great ambience for pictures. Romantics enjoy quality time, and di best place to have quality time is a serene environment with good slow music.

Skincare package

Getting your woman skincare package of her favorite brands is like showing that you see her efforts in trying to maintain a good skin and you appreciate it.

Clear her cart

Very simple, very straightforward. If you no dey too sure about wetin you go give your woman, ask her to calculate everything wey dey her shopping cart and send her di money to clear it.

Conclusion

Even as people de try surprise their loved ones this period, remember sey every relationship dey different. Some people no too gbadu surprises. So before you decide to go hunting for gift ideas, try to understand whether you partner go value di gift. If you’re not sure, simply ask them wetin them go like for Valentine’s day.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *