Ashmusy wey be social media influencer, collect ₦1million for August 2023 to do advert for one construction supply brand wey dey Mainland, Lagos
She collect di money but she no do di advert. Di brand later ask am after two months make she do wetin she collect money for. She ignore dem. Dem continue to pressure am, then she talk say di place far, make dem send another ₦1.5million join di ₦1million wey dem don pay am already. As the brand tell am say they no get ₦1.5million to give am make she refund di first ₦1million wry dem pay am, she reply them say make dem forget di first ₦1million for her, Afterall she be “Fine Girl”. Wahala dey.
So, di brand demand full refund because “wetin she dey talk no dey make sense again”. Ashmusy no gree and finally she come talk say she go refund but e go take 4-6 weeks.
When di 6 weeks don almost reach to end, di brand sofri send am small reminder say if she no refund di money, dem go involve authorities. Ashmusy talk say “You no fit do anything. If you report to authorities, I go leave Nigeria.”
And na there di matter end. She no send di money even after di 6 weeks pass since 2023. Until dem table di matter for Ratel Supreme Court.
VeryDarkMan carry di matter, call Ashmusy out. At first she deny. Then, VDM post more evidence wey show say she really scam di brand. As she see say di evidence don too much, Ashmusy refund di ₦1million under 10 hours.
VDM add say he sure say na wetin she dey do to many voiceless brands. Now, some Nigerians dey call make Pres. Tinubu make him chairman of EFCC.