Victor Osimhen no dey relent to give Nigerians wetin to talk about anytime wey him dorn the famous green-white-green jersey of the Super Eagles.
The guy just dey serious in pursuit of goals for both club and country, and this fact don raise major hope amongst fans sey maybe Osimhen go break the long-standing all time goal record of Nigeria’s national team legend Rashidi Yekini.

Victor Osimhen no dey too far at all from Yekini’s goal tally wey be 37 goals. This figure dey within the reach of the 2023 CAF Player of the Year.
After him score against Benin Republic in the fifth game of AFCON 2025 qualifiers on Thursday, 14 November 2024, Osimhen dey 14 goals away from equalling the Super Eagles iconic forward.
The future dey very bright for the Olusosun-born player wey overcome many childhood challenges to become a household name for Nigeria, Africa and beyond.

If him go maintain the performance trajectory wey dey ground so, as breaking this long-standing record go be a thrilling prospect for not just the player alone, but many Nigerians as well.
For now, Victor Osimhen don equal Segun Odegbami’s goal mark for Super Eagles in 2nd place with 23 goals, and him go continue to score in order to become the Super Eagles all-time highest goalscorer.
Victor Osimhen (37 caps) is now Nigeria's joint-second all-time top scorer, having matched Segun Odegbami's 23-goal record against Benin Republic. Only Rashidi Yekini has scored more, with 37 goals. Truly exceptional! pic.twitter.com/w9TlExR0xp
— Shina Oludare 🇳🇬 (@sportingshina) November 14, 2024
Victor Osimhen eyes Super Eagles all-time top scorer title
The weight of expectations dey for Osimhen shoulder as be now. With many years wey dey left on the plate for am, only time go tell.
This is the list of Super Eagles highest goal scorers in history:
- Rashidi Yekini – 37 goals in 58 appearances
- Victor Osimhen – 23 goals in 37 appearances
- Segun Odegbami – 23 goals in 46 appearances
- Yakubu Aiyegbeni – 21 goals in 57 appearances
- Ikechukwu Uche – 19 goals in 46 appearances
- Obafemi Martins – 18 goals in 42 appearances
- Sunday Oyarekhua – 17 goals in 28 appearances.
- Ahmed Musa – 16 goals in 109* appearances and counting
- Odion Ighalo – 16 goals in 37 appearances
- Samson Siasia – 16 goals in 51 appearances.