WAEC releases 2024 results

images 3 WAEC releases 2024 results

West African Examinations Council, AKA WAEC, don finally release results of di 2024 examination.

The council post for their X handle say dem don release the 2024 results for candidates.

Inside the tweet wey them post, them talk sey, “The West African Examinations Council dey happy as them dey inform their candidates wey write 2024 WASSCE sey their results don come out Monday 12 August 2024”.

After the news of the results wey them release, e show sey WAEC no release all the results. Them hold back 215,267 candidates WAEC results.

This 215,267 na like 11.92 per cent of the total number of candidates wey sit for the exams, and the number na 1,805,216.

This 2024 WASSCE exam been start on 30 April 2024 and e end on 24 June 2024.

Why some WAEC results were held

As him de announce the release of the 2024 WAEC results, the head of Nigerian office for WAEC, Dr. Amos Dangut talk sey the reason why them hold back some candidates WAEC results na because e dey connected to various cases of exam malpractice wey them report.

Him explain sey the 215,267 dey 4.37 per cent lower than the previous record. Sey for the previous record, na 16.29 per cent of the total candidates wey write the exams for 2023.

WAEC results
Students sitting for exams. Credit: WAEC

Dr. Dangut come add sey the council go continue to fight exam malpractice and any school, supervisor, teacher or student wey dey involved in malpractice dey undermine the educational system.

Even as them don talk sey make them no de use phones for exams, many people still dey use am. But them dey investigate the matter and them go send the reports for the investigation give the committee wey go decide on wetin to do.

Him add sey anything wey the committee decide on, them go communicate am to the candidates wey dey affected through their schools.

Dangut talk sey, 73.79 per cent of candidates get credit and above some get am plus maths and English, others no get maths, others no get English. That 73.79 per cent na 1,332,089 candidates be that, out of the 1,805,216 wey write the exams.

Him talk sey, as candidates de check their results, make them apply for their digital certificate wey them go release after 48 hours.

Candidates wey don complete their financial requirements fit get their results online for the council website within 12 hours. And then go send the copies of the result listing to the schools ASAP.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *