Saida Boj na de socialite and influencer wey don de trend after her talk for Nedu Podcast, many people come de ask sey who be Saida Boj gan gan?.
Her real name na Sarah Idaji Ojone but her social media name na Saida Boj, and na the name wey don de trend this week for Naija be that. She dey popular based on her controversial talks, but the real talk wey make her de trend now na the talk wey she talk for Nedu Podcast.
Wetin Saida Boj Talk For Nedu Podcast
Nedu na another socialite wey de host podcast de talk about different issues wey de go on for the country. Recently he host Sarah Idaji Ojone wey dem de call Saida Boj for him show. During the show, Saida Boj come talk sey, “she no de waste time to bill men wey de toast am, sey if any man begin talk to am for morning, she de bill am for night”.
She also talk sey if man wan knack am, the man go pay am #20mil sey she bin date one married man one time like that and she de regret am because the man no give am money, so she no de waste time bill men again.
Saida Boj Banned From Social Media
After the podcast wey trend for different social media, many people come provoke ontop the plenty things wey Sada Boj talk, sotey some celebrities like Erriga come drop their own two cents.
Many people including women come de insult Saida Boj sey na olosho she be, come de call am different names. As Saida Boj sef no wan looseguard fro anybody na, na so she come de reply to the people wey de insult am.
For the video wey she reply Erriga, she talk sey him wan use her revive him dead music career, sey even for Agbor Delta state her sisters no know am.
Na so we wake up yesterday see sey dem don take down her Facebook, Tiktok and Instagram accounts. Many people come de happy sey she deserve am, based on sey them no too gbadu wetin she talk.