Why VeryDarkMan dey trend

Verydarkman driving

VeryDarkMan dey trend because of him new video wey he talk say Iyabo Ojo lie about her invitation to Davido wedding, Chivido2024.

VeryDarkMan talk say Iyabo Ojo no get invite to the main wedding, na only the after party. According to am, “She no get level.”

Iyabo Ojo react to the tori as she post picture of her invitation, plus video of when she dey approach Davido for the event. She tell VDM make him comot her name for him mouth.

As you go expect, VDM don reply. He talk say he no go ever stop to drag am until she apologize to am for how she insult him mama. He still talk say the invitation wey she get na for the after party, and him sabi because he get the same one. But because him get level, he still enter the main event.

He also talk say Iyabo Ojo na hypocrite, she no like Davido, she just go there for social media validation.

For him original video, VeryDarkMan talk say many influencers and skit makers dey very far from the main event. And Nigerians no fit see am because he dey with superstar, Victor Osimhen.

Paul O, wey dem talk say na Iyabo Ojo partner and Priscilla Ojo don also come for VDM. He don respond to them too.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *