One video wey dey trend for social media platforms show sey VeryDarkMan (VDM) don dey tackle Bobrisky again.
This time around, VeryDarkMan or VDM as people de call am, release one voice recording wey him allege sey na Bobrisky voice dey inside.
Inside the voice recording, the voice wey him claim sey na Bob get am de talk about how him go try comot for Kirikiri wey him dey.
If you remember earlier this year, them been arrest Bobrisky because of money laundering. Sey him go owambe go de abuse Naira.
Every morning I thank God that VeryDarkMan is not an Igbo Man
If VeryDarkMan was Igbo,I know that he would be silenced or probably assassinated.
VeryDarkMan will live long to see Nigeria become better..Iseee!
Nnamdi Kanu will live long to see Igbos triumph..Iseee!#verydarkman— Nigerian Crypto Boy 🇳🇬 (@AlexBen85618969) September 25, 2024
Aftee him serve him 6-months jail term, him later comot. Now, e be like some people get OT sey him no really go kirikiri, him been lodge for one apartment de chill.
Na so them gather evidence send VDM. Inside the voice recording, the voice wey VDM talk sey na Bobrisky voice dey try find wey make them pardon am.
Him mention some names of other top people like Falz, Femi Falana (SAN) and other people wey dey involved.
As usual, VDM don dey get clash with Bob tey tey, wetin really cause their beef no too clear, but according to VDM, wetin dey inside the voice recording na against the constitution, and e no supposed be so.
As him de record him own video to address the matter, him talk sey him respect for Barr. Femi Falana wey be Senior Advocate of Nigeria (SAN) done reduce. Sey Barr. Femi suppose sabi de law.
Also, Falz de support Bobrisky and later him go talk sey him de fight corruption. Wether Falz follow “de do?”.
In another news, EFCC don invite VDM and Bobrisky, sey make them show for their office.