Di Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don approve di immediate payment of ₦70,000 minimum wage for all workers under di FCT Administration.
Dis one dey inside statement wey Anthony Odeh, di Press Secretary to di Head of Civil Service of di FCT, sign and release to journalists on Tuesday.
Remember say President Bola Tinubu sign di Minimum Wage Bill into law for May 2024, approve N70,000 as di new minimum wage after months of negotiation with labour unions.
FCT NLC planned strike triggered Wike to approve the minimum wage
Reports been show say di FCT Chapters of di Nigerian Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) don plan to shut down activities on November 30, 2024, as part of di nationwide strike over di delay for implementing di new minimum wage for some states, including di FCT.
BREAKING NEWS: FCT minister Wike approves N70,000 minimum wage for FCT Abuja workers. pic.twitter.com/3q7GHT8uqP
— Nigeria Stories (@NigeriaStories) November 19, 2024
Dem also complain say Wike administration no meet with di labour unions since him enter office for August 2023.
However, di statement tok say Wike don approve di payment of di minimum wage on Monday, November 18, 2024, to reduce di hardship wey workers dey face.
Di Acting Head of Civil Service of FCT, Mrs Grace Adayilo, announce say di minister don also approve di payment of three months’ arrears for all staff, wey go start from November 2024.
She talk say dis move go encourage staff to support di minister for him effort to deliver on President Tinubu’s Renewed Hope Agenda.
Di statement conclude say di approval na part of di minister’s commitment to improve di welfare of FCT staff.