Di Economic Community of West African States, ECOWAS, don dey push for one currency for all di West African countries.
Today, members of di body sidon talk sey them wan push di plan go forward.
Wetin be ECOWAS?
ECOWAS na di abbreviation for Economic Community of West African States. Na community of 15 African countries wey dey inside West Africa like Nigeria, Ghana, Benin Republic, Niger, Mali, Burkina Faso, Cape Verde, Cote D’Ivoire, The Gambia, Guinea, Guinea Bissau, Senegal, Sierra Leone, Togo, and Liberia.
Wetin ECOWAS talk?
Leader of ECOWAS don decide sey them go introduce new currency, wey all di countries wey dey under ECOWAS go de use. Di name of di new currency na eco, and na 2027 them propose sey them go start to use am.
This currency suppose launch since 2020 but because of convid 19 wey affect so many things, them come push di launch date forward. Na why them hold di 66th Ordinary Session for Abuja make them discuss di launch date for di currency.
Why ECOWAS wan launch new currency?
According to wetin them talk, this new currency go help solve some problems wey don already dey ground. Problems wey dey affect intraregional transactions between di ECOWAS states. E go also help di economy of all di ECOWAS nations.