Meaning of IJGB in Nigeria

IJGB is a popular returnee talk

IJGB na very common slang wey don tey for Nigerian social media space. Even though e don tey wey e comot, no be every body sabi wetin e mean because na only specific times them de use am.

Like now wey Christmas don dey reach, many people don de use di slang wella for their social media. If you don de wonder wetin IJGB mean for Nigerian slang, we don explain am in full for this article.

IJGB meaning

IJGB na abbreviation wey stand for, I Just Got Back. Na from this words them pick the first letters form di slang IJGB.

Just as the words talk, na slang wey them de use to describe people wey just de come back from Yankee.
Normally na men wey de come do Christmas Oblee before them go back their country.

Who is an IJGB?

Even as many people de come back come do detty December, no be all of them be IJGB. IJGB na for specific kind of men wey de like whyne women during Christmas make them for spend time with them. Them fit de speak fone, and make plenty promises wey them no de keep.

Some IJGB de deceive girls sey them two dey inside relationship. And as some girls de like abroad guys, them de fall for di scope. Di IJGB men go give them plenty lamba make them for spend time with them. Later on them go leave them go back their countries.
One common thing with this IJGB guys na sey, most times na married men wey leave their oyinbo wife and children for abroad.

Conclusion

Even as many people don de come back come do Christmas, no be all of them be IJGB. IJGB na those men wey de like show off make them for take deceive girls.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *