This tori about two missing girls in Aba don dey trend now. The tori be sey, two friends Celine Ndudim and Afiba Tandoh travel from Port Harcourt go Aba to visit one man wey them meet for Facebook, but e pass one week wey their people no hear from them, na there them know sey something sup.
As them start to dig the details, them come find out sey di man wey them go visit, na one Mr. Andrew Amaechi Ochekwe and him de work for one company wey Di name na Black Sheep.
The news about the two missing girls in Aba come go round, na so one popular activist Harrison Gwamishu start the dig am more. And as him dig, him come find some videos wey Andrew bin send to both Celine and Afiba before them reach him side.
But di shocking thing be sey, no be only Celine and Afiba video dey, plenty other videos wey Mr. Andrew de do with other girls wey him meet dey. And for di video, e show sey di man get him pattern of doing things, because na di same restaurant him de carry di girls go.
More girls confide in Harrison sey them sef be victim for di man hand. Some tok sey him rape them for their nyash, and na small thing like this him for use beating kpai them.
Two Missing Girls In Aba Linked To Black Sheep?
Black Sheep na di name of di company wey Andrew de work. But as things come happen like this, many people come de wonder whether di company na legit abi na ritualist company.
After more digging and evidence comot, Harrison go post for him Instagram page sey, him don discover sey Mr. Andrew na organ harvester and E be like him no dey alone.
Where di matter come tie wrapper na sey, e get one time wey Harrison tok sey them bin arrest Mr. Andrew, and in di process of make them transfer am from Aba reach Abuja, popo come kill am, based on sey him try to escape.
Many people come de ask questions sey di tok fit no be true since evidence for where them kill am no dey. But Harrison never reply that one, instead, him bring new update give Nigerians.
For di new update, Harrison tok sey them find deadi bodi wey them butcher near Mr. Andrew house for Aba. Sey di head of di deadi bodi no dey and them use one curtain wrap di body. Him con show sey di curtain wey them use wrap di deadi bodi resemble di one wey dey for Me. Andrew house.
Many people come de react to di news de tok wetin dey their mind. Some de talk sey di girls deserve wetin their eyes see, while others the insist sey lie lie, them no believe sey popo kpai Andrew, sey if na true make them provide evidence.