Some people get enough joy this democracy day, June 12, 2024 as Burna Boy visits UTHPH clear di whole hospital bill for di people wey dey di hospital.
Nigerian musician Damini Ogulu wey dem de call Burna Boy almost cause wahala for University Teaching Hospital Port Harcourt as him visit there when him d travel go him village.
Inside one of di videos wey de fly for internet, many pipo wey dey di hospital de shout like sey dem go fall as dem see Burna.
Video: https://youtu.be/ZQigYsbA9n4?si=_SrUONq3Z07huTGz
Wetin dem later tok be sey Burna Boy no just waka pass di hospital, sey him pay all di hospital bill for pipo wey dey di hospital.
Another tok be sey, him no stop there, him give #10 million to some students wey dey di university make dem take use am hol bodi and soul together.
Wetin him do come show sey true true, na Odogwu him be, and him get enough evidence.