Mr. Farooq steal di hearts of many Nigerians with him clean pictures wey de trend for internet.
Him na di start of 2024 Ojude Oba festival wey happen for Ijebu Ode, Ogun state.
This festival wey them de use pay tribute to the Awujale of Ijebu land de showcase different people with different styles and dress sense,.and Mr. Farooq happen to be one of di people wey enter Naija people eye.
As their mind no touch ground, Nigerians de dig about am, some de ask who him be.
Mr. Farooq Oreagba na person wey don work for finance for over two decades, that na 20 years be that.
Like this now, na him be di Managing Director for NG Clearing Limited. This MD position wey him de occupy na last year them give am.
Not only that, Mr. Farooq na cancer survivor wey beat shege comot cancer body since over five years ago.
Despite sey di cancer shake am small, them later declare am cancer free for 2017.
Since after that time, e dey clear sey Oreagba de live him normal life stress free and with plenty swag and steeze and him display for di Ojude Oba event.