EFCC allegedly investigating VeryDarkMan

Meet VeryDarkMan, a popular social media activist

In a recent video posted on his Instagram account, former Big Brother Naija housemate and comedian, Deeone don talk sey di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC dey investigate Martins Otse alias, VeryDarkMan (VDM) account.

This news dey come months after di self acclaimed human rights activist, VDM comot talk sey them hack him NGO website move over ₦100 million wey people donate for am.

According to wetin Deeone talk, di petition to investigate di account was submitted by one unnamed person who wanted to know di truth about di money.

From di document wey Deeone attach to di video, di petition to investigate Martins Vincent Otse dey show sey na since December 10 di matter start.

VeryDarkMan under investigation over mismanagement of foundation funds

In one part of di video Deeone talk sey VeryDarkMan been withdraw ₦20 million from di NGO money take deposit for Range Rover, after him talk about am, VeryDarkMan stylishly return di money come publish fake account statement.

Challenging di EFCC to do their work so that di truth go comot, Deeone talk sey VDM been accuse di EFCC of collecting bribe so him want make di EFCC prove themselves whether them go collect bribe for this case or not.

Him also pledge sey if him dey wrong with wetin him talk, make them also sue am, but if him no dey wrong, make di truth come out as di whole point of di investigation na sey make di NGO work.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *